Any ways, I came out of a relationship and bros was still here but as friend because again he dey naija. Bros still stylishly ask me for a relationship, wey i make am clear say e no interest me.
Last yr sha, bros came to yankee and we met for the first time. Again, he said he wan marry me...because of family pressure to marry, i said yes.
Now, my problem is I dont find bros attractive at all, i no see much prospective in him but his personality dey ok and he seems to love me. E be like say he know i no like am like that but he sha wan force am make e gel. IF i provoke to point wey I feel say e go let go, bros go do strong head and come back as sweet as ever.
I dont see him my oga at the top but I'm confused if say i go let something good go or bros just wan use me enter canada to better himself. As i know hin leg no balance well for naija but he dey make ends meet. I think say he no say I no like because na him to force make i call am pet names, he dont complain say i no dey call etc. Thing dey clear say i no dey show much love interest.
I no fit discuss with mama because her and my papa like the guy. I dont like bros more than friend and definitley dont see him adding any real value to my life besides to say I have husband.
Make una epppp me

Wetin una think about the situation? Shey the love fit grow, bros wan use me for one chance enter yankee or make i kuku drop it and move on.
No comments:
Post a Comment